english
stringlengths
19
466
pidgin
stringlengths
7
510
Surely I have calmed and quieted my soul, Like a weaned child with his mother; Like a weaned child is my soul within me.
Instead, I dey kwayet and dey silent like pikin wey nor dey kry for breast milk again. Yes, I kwayet like pikin wey en mama karry.
Her priests have violated My law and profaned My holy things; they have not distinguished between the holy and unholy, nor have they made known the difference between the unclean and the clean; and they have hidden their eyes from My Sabbaths, so that I am profaned among them.
Di priests break my law and dem nor dey respet anytin wey dey holy. Dem nor know wetin dey holy or not. Dem forget di Sabat; dem nor dey tish about wetin dey klean again. So bikos of dis, Israel pipol nor dey gri respet mi again.
For the people of Ammon and Moab stood up against the inhabitants of Mount Seir to utterly kill and destroy them. And when they had made an end of the inhabitants of Seir, they helped to destroy one another.
Ammon and Moab men attack di men wey kom from Mount Seir kon distroy dem. Wen dem kill Seir men finish, dem kon start to kill demsef.
Then the mariners were afraid; and every man cried out to his god, and threw the cargo that was in the ship into the sea, to lighten the load. But Jonah had gone down into the lowest parts of the ship, had lain down, and was fast asleep.
Di sailors kon dey fear; evribody bigin kry kon dey pray to dia difren juju. Den dem kon dey trowey dia load for wota make di ship for lite. By dis time, Jonah dey inside-inside di ship dey sleep.
But the Pharisees said, “He casts out demons by the ruler of the demons.”
But di Farisee pipol sey, “Na devil pawa Jesus dey use take drive demon komot from pipol body.”
If it is a matter of strength, indeed He is strong; And if of justice, who will appoint my day in court?
Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?
Now it shall come to pass in the latter days That the mountain of the Lord ’s house Shall be established on the top of the mountains, And shall be exalted above the hills; And all nations shall flow to it.
Time dey kom wen di mountin where di temple dey, go dey important pass evry oda mountin. Many nashons go-go der
knowing this: that the law is not made for a righteous person, but for the lawless and insubordinate, for the ungodly and for sinners, for the unholy and profane, for murderers of fathers and murderers of mothers, for manslayers,
God nor give di law, bikos of good pipol, but na for pipol wey dey disobey and do anyhow. Dis kind pipol dey like to sin and dem nor dey fear God. Dem nor dey holy or get respet for anytin and dem fit kill dia papa, mama or anybody.
That you may take it to its territory, That you may know the paths to its home?
Yu fit show dem how far dem fit go or send dem go house?
Then David called one of the young men and said, “Go near, and execute him!” And he struck him so that he died.
Den David kon tell one of en men, “Make yu kill-am!” Di man kon kill di Amalek man,
The sons of Issachar were Tola, Puah, Jashub, and Shimron—four in all.
Issakar four sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.
Where are the gods of Hamath and Arpad? Where are the gods of Sepharvaim? Indeed, have they delivered Samaria from my hand?
Where Hamat and Arpad gods dey naw? Where Sefarvaim gods dey sef? E get anybody wey save Samaria?
They also set up false witnesses who said, “This man does not cease to speak blasphemous words against this holy place and the law;
Dem bring pipol kon lie sey, “E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins about Moses Law and dis Temple.
Why do You show me iniquity, And cause me to see trouble? For plundering and violence are before me; There is strife, and contention arises.
Why Yu allow mi dey face dis kind trobol? Must I si all dis wahala wey dey happen to mi? Anywhere wey I look, na only wahala and distroshon I dey si. Na pipol wey love to kworel and fight, dey round mi.
Thus with your mouth you have boasted against Me and multiplied your words against Me; I have heard them. ”
I hear as una dey make mout and curse mi.
“Why do you beautify your way to seek love? Therefore you have also taught The wicked women your ways.
Una really know how to run follow di pesin wey una love and bikos of dis, even ashawo, don learn join en work, bikos of wetin una dey do!
“For behold, the day is coming, Burning like an oven, And all the proud, yes, all who do wickedly will be stubble. And the day which is coming shall burn them up,” Says the Lord of hosts, “That will leave them neither root nor branch.
Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.
I will destroy your high places, cut down your incense altars, and cast your carcasses on the lifeless forms of your idols; and My soul shall abhor you.
I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
And a fire came out from the Lord and consumed the two hundred and fifty men who were offering incense.
Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.
He cuts down cedars for himself, And takes the cypress and the oak; He secures it for himself among the trees of the forest. He plants a pine, and the rain nourishes it.
E kut cedar tree, kollect oak or cypress tree and oda tree from forest. E plant cedar seed and rain kon make am grow,
“And you shall take fine flour and bake twelve cakes with it. Two-tenths of an ephah shall be in each cake.
“Una must take twelf kilogram of flower kon bake twelf bread,
You will save the humble people; But Your eyes are on the haughty, that You may bring them down.
Yu dey save pipol wey dey honbol, but Yu dey honbol pipol wey dey proud.
And daily in the temple, and in every house, they did not cease teaching and preaching Jesus as the Christ.
So evriday for di temple kompond and from house to house, dem kontinue to dey tish and prish di Good News sey, “Na Jesus Christ bi di Mezaya.”
Then the king answered the people roughly, and rejected the advice which the elders had given him;
Di king nor listin to di old pipol advise, instead e tok to dem anyhow, just
And the chief priests accused Him of many things, but He answered nothing.
Den di priest oga dem still dey akuiz am,
And all the oxen for the sacrifice of peace offerings were twenty-four bulls, the rams sixty, the male goats sixty, and the lambs in their first year sixty. This was the dedication offering for the altar after it was anointed.
All di animals wey dem sakrifice for peace ofrin na twenty-four small melu, sixty ram, sixty man goat and sixty lamb wey bi one year. Dis na di whole ofrin wey dem give to take dedikate di altar afta dem don anoint am.
You have given him his heart’s desire, And have not withheld the request of his lips. Selah
Yu don gi-am evritin where e wont and na evritin wey e ask for, Yu gi-am.
“Yet the number of the children of Israel Shall be as the sand of the sea, Which cannot be measured or numbered. And it shall come to pass In the place where it was said to them, ‘You are not My people,’ There it shall be said to them, ‘ You are sons of the living God.’
But di time dey kom wen Israel pipol go plenty like san-san for sea wey nobody fit kount or measure. Aldo God dey sey, “Una nor bi my pipol,” but di day dey kom wen God go sey, “God wey nor dey die, na-im bi una papa!”
The word that the Lord spoke to Jeremiah the prophet, how Nebuchadnezzar king of Babylon would come and strike the land of Egypt.
Wen King Nebukadnezzar kom attack Egypt, God tell mi sey,
“Though you, Israel, play the harlot, Let not Judah offend. Do not come up to Gilgal, Nor go up to Beth Aven, Nor swear an oath, saying, ‘As the Lord lives’—
But even doh Israel pipol nor dey faithful to mi, make una, Judah pipol nor bihave like dem. Make una nor go woship for Gilgal or Bethel or use God name take make promise for der.
The Lord preserves all who love Him, But all the wicked He will destroy.
God dey protet all di pipol wey love am, but E dey distroy wiked pipol.
and they spoke to Moses, saying, “The people bring much more than enough for the service of the work which the Lord commanded us to do.”
Dem go meet Moses kon sey, “Di tins wey di pipol don give don too many to komplete di work wey God kommand sey make wi do!”
for which I was appointed a preacher and an apostle—I am speaking the truth in Christ and not lying— a teacher of the Gentiles in faith and truth.
Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).
For he stretches out his hand against God, And acts defiantly against the Almighty,
bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
Charm is deceitful and beauty is passing, But a woman who fears the Lord , she shall be praised.
Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear, but make pipol praiz woman wey dey honor and fear God.
Our fathers trusted in You; They trusted, and You delivered them.
Awa grand-grand papa dem trust Yu and Yu save dem.
I had no rest in my spirit, because I did not find Titus my brother; but taking my leave of them, I departed for Macedonia.
my mind nor rest, bikos I nor si awa broda, Titus, for der. So I leave der kon go Masidonia.
Immediately he went up to Jesus and said, “Greetings, Rabbi!” and kissed Him.
At wons, Judas go meet Jesus, greet am kon sey, “Tisha”, den e kiss am.
Then Jesus answered and said to her, “O woman, great is your faith! Let it be to you as you desire.” And her daughter was healed from that very hour.
So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
He spoke to them in the cloudy pillar; They kept His testimonies and the ordinance He gave them.
E tok to dem from di kloud wey kom as pila and dem obey en kommand and laws wey E give dem.
The Lord has spurned His altar, He has abandoned His sanctuary; He has given up the walls of her palaces Into the hand of the enemy. They have made a noise in the house of the Lord As on the day of a set feast.
God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.
And the dragon was enraged with the woman, and he went to make war with the rest of her offspring, who keep the commandments of God and have the testimony of Jesus Christ.
Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ.
And they rose early in the morning and went up to the top of the mountain, saying, “Here we are, and we will go up to the place which the Lord has promised, for we have sinned!”
Early di next morning, dem start to travel go di hill kountries kon sey, “Naw wi don ready to go di place wey God don dey tell us. Wi know sey wi don sin.”
Suddenly seven cows came up out of the river, fine looking and fat; and they fed in the meadow.
Den I si seven melu wey fine well-well dey kom out from di river go chop for di field.
Now the Philistines fought against Israel; and the men of Israel fled from before the Philistines, and fell slain on Mount Gilboa.
Filistia pipol fight with Israel pipol for Gilboa mountin. Dem kill many Israel pipol for der and di ones wey remain, run komot from der.
Then they will know that I am the Lord , When I have set a fire in Egypt And all her helpers are destroyed.
Wen I don put fire for Egypt and all di sojas wey dey guide am don die finish, den dem go know sey na mi bi God.
So when the woman saw that the tree was good for food, that it was pleasant to the eyes, and a tree desirable to make one wise, she took of its fruit and ate. She also gave to her husband with her, and he ate.
Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
Then the Spirit took me up and brought me in a vision by the Spirit of God into Chaldea, to those in captivity. And the vision that I had seen went up from me.
Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon. Den di vishon kon finish
And Ahab told Jezebel all that Elijah had done, also how he had executed all the prophets with the sword.
King Ahab tell Jezebel all wetin Elijah do and how e kill all di Baal profets with en swod.
The great God who formed everything Gives the fool his hire and the transgressor his wages.
Like pesin wey dey shot en arrow anyhow, na so too e bi to pesin wey hire fool take work.
Then they defeated all the cities around Gerar, for the fear of the Lord came upon them; and they plundered all the cities, for there was exceedingly much spoil in them.
Dem win all di towns near Gerar, bikos God make dis towns run with fear. Judah men karry dia propaty go house, bikos di propaty for di towns many well-well.
For the cry has gone all around the borders of Moab, Its wailing to Eglaim And its wailing to Beer Elim.
True-true, pipol dey hear as Moab pipol dey kry for evriwhere and dia kry dey rish Eglaim and Beer-Elim town.
For laying aside the commandment of God, you hold the tradition of men —the washing of pitchers and cups, and many other such things you do.”
Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”
for when Gentiles, who do not have the law, by nature do the things in the law, these, although not having the law, are a law to themselves,
Gentile pipol nor get di law, but dem dey use dia sense do wetin di law tok and dat one don turn law for dem, even doh dem nor know Moses Law.
And the men of Shechem set men in ambush against him on the tops of the mountains, and they robbed all who passed by them along that way; and it was told Abimelech.
Shekem leaders hide some men for bush dey wait Abimelek and to rob anybody wey pass der. But Abimelek kon know about dia plan.
The standard of the camp of the children of Judah set out first according to their armies; over their army was Nahshon the son of Amminadab.
Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem.
There was a relative of Naomi’s husband, a man of great wealth, of the family of Elimelech. His name was Boaz.
E get one man wey rilate to Naomi husband, Elimelek family and en name na Boaz. E get money well-well and pipol know am for evriwhere for Betlehem.
“Behold, I set before you today a blessing and a curse:
Si, today I dey give una shance to pick between blessing and curse!
But he who did his neighbor wrong pushed him away, saying, ‘Who made you a ruler and a judge over us?
But di man wey dey opress en broda kon sey, ‘Who give yu pawa to rule and judge us?
Then Pharaoh called to Moses and said, “Go, serve the Lord ; only let your flocks and your herds be kept back. Let your little ones also go with you.”
Den Fero send for Moses kon tell am, “Make una go serve di Oga una God, both una and una family, but una animals go dey here for Egypt.”
Then they despised the pleasant land; They did not believe His word,
So some pipol nor enter di promise land, bikos dem nor bilive God promise wey sey, E go kare for dem.
My skin grows black and falls from me; My bones burn with fever.
My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.
Maaziah, Bilgai, and Shemaiah. These were the priests.
Maazaih, Bilgai and Shemaya.
As for the saints who are on the earth, “They are the excellent ones, in whom is all my delight.”
Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.
He also shall be my salvation, For a hypocrite could not come before Him.
E fit bi sey my boldness fit save mi, bikos know wiked pesin go try sey e won face God.
And yet this was a small thing in Your sight, O God; and You have also spoken of Your servant’s house for a great while to come, and have regarded me according to the rank of a man of high degree, O Lord God.
Yu even do di ones wey big pass dis ones! Even my grand-grand shidren wey dem neva born, Yu don promise dem many tins! My Oga God! Why Yu dey trit mi like one big man?
“But we have shot at them; Heshbon has perished as far as Dibon. Then we laid waste as far as Nophah, Which reaches to Medeba.”
Wi don ova pawa dem; from Heshbon go rish Dibon and all dia pipol don die finish. Wi don skata dem go rish Nofah wey dey near Medeba.”
So Saul said to his servants, “Provide me now a man who can play well, and bring him to me.”
So Saul tell en savants, “Make una fine one man wey sabi play di jita kom meet mi.”
Then Hananiah the prophet took the yoke off the prophet Jeremiah’s neck and broke it.
Hananaya take di wood wey dem tie for my neck komot kon break am to pieces,
“Thus says the whole congregation of the Lord : ‘What treachery is this that you have committed against the God of Israel, to turn away this day from following the Lord , in that you have built for yourselves an altar, that you might rebel this day against the Lord ?
“Evribody for Israel wey bi God own sey make wi ask una, ‘Wetin make una disobey Israel God as una don turn from am.
But the men were very good to us, and we were not hurt, nor did we miss anything as long as we accompanied them, when we were in the fields.
Di men dem dey good to us. Dem nor curse or wound us wen wi dey with dem for di field.
Our inheritance has been turned over to aliens, And our houses to foreigners.
Strenjas don take all wetin wi get and na dem dey stay for awa town naw.
So he said to his brothers, “My money has been restored, and there it is, in my sack!” Then their hearts failed them and they were afraid, saying to one another, “What is this that God has done to us?”
Den e tell en brodas, “Dem return my money give mi! E dey for inside my sak!” Dem sopraiz well-well kon turn face each oda with fear, den dem sey, “Na wetin God don do to us so?”
Now it was a Sabbath when Jesus made the clay and opened his eyes.
(bikos na for Sabat Day Jesus spit for san-san take rub di blind man eye).
“Even when they made a molded calf for themselves, And said, ‘This is your god That brought you up out of Egypt,’ And worked great provocations,
even wen dem make juju wey bi like melu kon sey na di god wey lead dem komot from Egypt! Si as dem curse Yu rish!
Now the king of Syria had commanded the captains of the chariots who were with him, saying, “Fight with no one small or great, but only with the king of Israel.”
Siria king don kommand en kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king.
and watch; and just when the daughters of Shiloh come out to perform their dances, then come out from the vineyards, and every man catch a wife for himself from the daughters of Shiloh; then go to the land of Benjamin.
Anytime una si di yong wimen for Shiloh kom out kon dance for di festival, una go rush kom out kon katch dem one-by-one go house for Benjamin town as una wife!
In transgressing and lying against the Lord , And departing from our God, Speaking oppression and revolt, Conceiving and uttering from the heart words of falsehood.
Wi don fight, rijet and refuse to follow Yu. Wi opress odas kon turn from Yu. All wetin wi dey tok and tink, na lie dem bi.
There was a man sent from God, whose name was John.
E get one man wey en name bi John, wey God send kom dis world.
Then I arose in the night, I and a few men with me; I told no one what my God had put in my heart to do at Jerusalem; nor was there any animal with me, except the one on which I rode.
I nor tell anybody wetin God put for my mind make I kom do for Jerusalem. Den for mid-nite, I wake-up kon take some among my men follow body with only one donkey wey I ride.
“All clean birds you may eat.
Una fit chop any bird wey dey klean.
The princes refrained from talking, And put their hand on their mouth;
Di leaders wey dey lead di pipol go stop to tok.
Wondrous works in the land of Ham, Awesome things by the Red Sea.
and plenty wonderful tins for Ham and for di Red Sea.
One basket had very good figs, like the figs that are first ripe; and the other basket had very bad figs which could not be eaten, they were so bad.
Na good fig full di first basket; figs wey kwik ripe; but na bad fig wey dem nor go fit chop dey di sekond one.
But I see another law in my members, warring against the law of my mind, and bringing me into captivity to the law of sin which is in my members.
but inside mi, I kon undastand sey sometin dey fight against my mind and e dey make mi bi sin savant, bikos e dey kontrol my body.
but you shall go to my country and to my family, and take a wife for my son Isaac.”
Instead, make yu go my village go meet my relashon kon find wife among dem for my pikin Isaak.”
For even if I made you sorry with my letter, I do not regret it; though I did regret it. For I perceive that the same epistle made you sorry, though only for a while.
Bikos even if I make una vex with my leta, e nor pain mi sey I rite am (even doh e pain mi as I know sey e make una vex, aldo una vexnashon nor tey).
The hope of the righteous will be gladness, But the expectation of the wicked will perish.
Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.
to Him be glory in the church by Christ Jesus to all generations, forever and ever. Amen.
Make all glory for Christ church bi en own from one generashon go rish anoda. Amen!
So they said to Him, “Where do You want us to prepare?”
Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”
If he dedicates his field from the Year of Jubilee, according to your valuation it shall stand.
If e klean en field for di year wen dem dey free pipol, den di land go bi di normal prize.
The servant therefore fell down before him, saying, ‘Master, have patience with me, and I will pay you all.’
“So, di savant fall for di king front dey beg, ‘Oga God, make yu dey patient with mi, I go pay yu evritin.’
So He said to them, “How is it you do not understand?”
Den Jesus tell dem, “Una neva still undastand?”
who killed both the Lord Jesus and their own prophets, and have persecuted us; and they do not please God and are contrary to all men,
Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.
“Whereas you have been forsaken and hated, So that no one went through you, I will make you an eternal excellence, A joy of many generations.
Dem nor go hate and look down on una again. Una town wey dem skata and distroy, I go make am great and beautiful and joy go dey der forever and ever.
and when they return to You with all their heart and with all their soul in the land of their captivity, where they have been carried captive, and pray toward their land which You gave to their fathers, the city which You have chosen, and toward the temple which I have built for Your name:
Wen dem turn kom meet Yu with all dia heart and mind for di land where dem for dey sofa kon dey pray as dem face dis land wey Yu give dia grand-grand papa and di town wey Yu choose with di temple wey I build to honor Yu,
And seven sons and three daughters were born to him.
E born seven sons and three dotas.
But if you refuse to let them go, behold, I will smite all your territory with frogs.
But if yu nor gri release dem, den I go make frog kover una land and una go sofa.
And there you shall eat before the Lord your God, and you shall rejoice in all to which you have put your hand, you and your households, in which the Lord your God has blessed you.
For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.
He judged Israel twenty-three years; and he died and was buried in Shamir.
E lead Israel pipol for 23 years before e die and dem beri am for Shamir.