english
stringlengths
19
466
pidgin
stringlengths
7
510
He has made the earth by His power, He has established the world by His wisdom, And has stretched out the heavens at His discretion.
Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.
When they told David, he sent to meet them, because the men were greatly ashamed. And the king said, “Wait at Jericho until your beards have grown, and then return.”
Shame nor let di men go back to dia house. Wen David hear wetin happen, e send message go meet dem sey make dem stay Jeriko till dia hair go grow again.
I did not know Him, but He who sent me to baptize with water said to me, ‘Upon whom you see the Spirit descending, and remaining on Him, this is He who baptizes with the Holy Spirit.’
I nor know am before, but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey, ‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’
Unto the upright there arises light in the darkness; He is gracious, and full of compassion, and righteous.
Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.
Sever yourselves from such a man, Whose breath is in his nostrils; For of what account is he?
So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?
one kid of the goats as a sin offering;
one man goat for klean ofrin;
Then the tribes of Israel sent men through all the tribe of Benjamin, saying, “What is this wickedness that has occurred among you?
Israel pipol send message go Benjamin tribe sey, “Wetin bi dis wiked tin wey una do so?
Who can utter the mighty acts of the Lord ? Who can declare all His praise?
Who fit kount all di wonderful mirakles wey God don do? Who go fit praiz am rish?
But it is good to be zealous in a good thing always, and not only when I am present with you.
But e good make una dey trit odas well, so-far una dey do am with betta mind and nor bi only wen I dey with una.
And they burn to the Lord every morning and every evening burnt sacrifices and sweet incense; they also set the showbread in order on the pure gold table, and the lampstand of gold with its lamps to burn every evening; for we keep the command of the Lord our God, but you have forsaken Him.
Dem dey give God sakrifice wey get betta fine smell both for morning and evening. Dem dey gi-am bread ofrin for klean tabol kon lite di lamp put for di gold lampstand for evening. Wi dey do wetin God sey make wi do, but una don rijet am.
So Joseph recognized his brothers, but they did not recognize him.
Josef know en brodas, but dem nor know am.
The baptism of John—was it from heaven or from men?”
John baptizim kom from heaven, abi na from pipol?”
For wrath kills a foolish man, And envy slays a simple one.
Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
So the Lord gave to Israel all the land of which He had sworn to give to their fathers, and they took possession of it and dwelt in it.
So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der.
In his days Hiel of Bethel built Jericho. He laid its foundation with Abiram his firstborn, and with his youngest son Segub he set up its gates, according to the word of the Lord , which He had spoken through Joshua the son of Nun.
For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.
That they may successfully do evil with both hands— The prince asks for gifts, The judge seeks a bribe, And the great man utters his evil desire; So they scheme together.
Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.
But when the children of Israel cried out to the Lord , the Lord raised up a deliverer for them: Ehud the son of Gera, the Benjamite, a left-handed man. By him the children of Israel sent tribute to Eglon king of Moab.
But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift.
The sons of Merari by Jaaziah were Beno, Shoham, Zaccur, and Ibri.
From Merari family thru Jaazaya di leaders na Beno, Shoham, Zakkur and Ibri.
And when she opened it, she saw the child, and behold, the baby wept. So she had compassion on him, and said, “This is one of the Hebrews’ children.”
Wen e open di basket, e kon si di boy inside dey kry. Fero dota sorry for di pikin kon sey, “Dis go bi one Hibru woman pikin.”
from the house of Gilgal, and from the fields of Geba and Azmaveth; for the singers had built themselves villages all around Jerusalem.
Dem still kom from Bet-Gilgal and di poor arias near Gibeah and Azmavet, bikos doz wey dey sing don build dia own house round Jerusalem.
‘For thus says the Lord God : “Indeed I Myself will search for My sheep and seek them out.
“ ‘Mi wey bi God wey get pawa dey tell unasef sey, mi mysef go look and kare for my sheep,
Then the fame of David went out into all lands, and the Lord brought the fear of him upon all nations.
David story spread go evriwhere and God kon make all di nashons dey fear am.
Sarah lived one hundred and twenty-seven years; these were the years of the life of Sarah.
Sarah stay for one hundred and twenty-seven years.
And it came to pass on the way, at the encampment, that the Lord met him and sought to kill him.
Naw, nite meet dem for road, so dem stop for one house kon sleep der. For nite wen dem dey sleep, God won kon kill Moses for di place.
He shall regard the prayer of the destitute, And shall not despise their prayer.
Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.
Then the eyes of the blind shall be opened, And the ears of the deaf shall be unstopped.
Den blind eyes go open and doz wey nor dey hear, go hear word.
And Aaron shall bring the goat on which the Lord ’s lot fell, and offer it as a sin offering.
Aaron go sakrifice di goat wey dem choose thru di dice wey dem trow kon gi-am as sin ofrin.
No one shall suffer miscarriage or be barren in your land; I will fulfill the number of your days.
Evry woman go get shidren and doz wey get belle for una land, go must born pikin and una go get long life.
But I say to you, it will be more tolerable for Tyre and Sidon in the day of judgment than for you.
but I tell una true word, e go eazy for Tyre and Sidon for judgement day pass una.
These were the sons of Zibeon: both Ajah and Anah. This was the Anah who found the water in the wilderness as he pastured the donkeys of his father Zibeon.
Na Zibeon sons bi dis: Aiaya and Anah (wey si di hot spring for di wildaness as e dey guide di animals wey bi en papa Zibeon own).
For she did not know That I gave her grain, new wine, and oil, And multiplied her silver and gold— Which they prepared for Baal.
But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.
Gladness is taken away, And joy from the plentiful field; In the vineyards there will be no singing, Nor will there be shouting; No treaders will tread out wine in the presses; I have made their shouting cease.
Nobody get joy or dey happy and inside di vineyard; nobody dey dance or shaut; no grape even dey to press to make wine, bikos I don end dia shaut for joy.
And it shall be that whichever of the families of the earth do not come up to Jerusalem to worship the King, the Lord of hosts, on them there will be no rain.
If any nashon nor gri go woship Oga God wey bi King, wey dey lead heaven sojas, rain nor go fall for dia land.
For it has been declared to me concerning you, my brethren, by those of Chloe’s household, that there are contentions among you.
Bikos I don hear thru Khloe family sey, una dey kworel among unasef.
Go immediately to King David and say to him, ‘Did you not, my lord, O king, swear to your maidservant, saying, “Assuredly your son Solomon shall reign after me, and he shall sit on my throne“? Why then has Adonijah become king?’
make yu go meet David kon ask am, ‘My king, yu nor promise mi sey, Solomon my pikin go bi king? How kom Adonijah kon bi king naw?’ ”
It shall not be poured on man’s flesh; nor shall you make any other like it, according to its composition. It is holy, and it shall be holy to you.
Make una nor rub am for pipol body and make una nor make any oda oil wey bi like am. E dey holy and e must dey holy to una.
Then the men did so; they took two milk cows and hitched them to the cart, and shut up their calves at home.
So di men go do as di priest tell dem. Dem take two melu kon join dem to di truck; dem put dia pikin from di yard.
So then, my beloved brethren, let every man be swift to hear, slow to speak, slow to wrath;
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.
Now Eli was very old; and he heard everything his sons did to all Israel, and how they lay with the women who assembled at the door of the tabernacle of meeting.
Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.
So the Lord alone led him, And there was no foreign god with him.
Na God dey guide dem by ensef, e nor get any oda god wey dey with am.
The son of Shechaniah was Shemaiah. The sons of Shemaiah were Hattush, Igal, Bariah, Neariah, and Shaphat—six in all.
Shekanaya born only Shemaya and Shemaya sons na: Hattush, Igal, Baraya, Nearaya and Shafat. All of dem na six.
And there shall be a knob under the first two branches of the same, a knob under the second two branches of the same, and a knob under the third two branches of the same, according to the six branches that extend from the lampstand.
One of di small-small seed go dey under all di six branches wey kom out from di lampstand.
Listen, for I will speak of excellent things, And from the opening of my lips will come right things;
Make una listin to mi! I get betta words to tell una and na di rite words I dey tok so.
I have no greater joy than to hear that my children walk in truth.
Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.
And you shall make no covenant with the inhabitants of this land; you shall tear down their altars.’ But you have not obeyed My voice. Why have you done this?
I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’
Have mercy upon me, O God, According to Your lovingkindness; According to the multitude of Your tender mercies, Blot out my transgressions.
My God, make Yu sorry for mi, bikos of yor love where nor dey fail. Make Yu forgive mi my sins, bikos Yu dey sorry for pipol.
Once I have sworn by My holiness; I will not lie to David:
Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:
This is the word that came to Jeremiah from the Lord , after King Zedekiah had made a covenant with all the people who were at Jerusalem to proclaim liberty to them:
God tok to mi afta King Zedekaya and Jerusalem pipol don make agriment sey make dem free
They shall not offer wine offerings to the Lord , Nor shall their sacrifices be pleasing to Him. It shall be like bread of mourners to them; All who eat it shall be defiled. For their bread shall be for their own life; It shall not come into the house of the Lord .
Dem nor go fit offa wine ofrin or sakrifice give God for der. Oga God nor go asept any of una sakrifice bikos e go bi like food wey dem offa give dead body and doz wey chop am, nor go dey klean. Una go only dey chop am bikos of honga, but make una nor bring any one kom God temple.
Then Rezin king of Syria and Pekah the son of Remaliah, king of Israel, came up to Jerusalem to make war; and they besieged Ahaz but could not overcome him.
For dat time, King Rezin for Siria and Remalaya pikin, King Pekah for Israel kon attack Jerusalem. Dem fight King Ahaz, but dem nor fit konker am.
the eighth for Jeshaiah, his sons and his brethren, twelve;
Before Jeshaaya and twelf of en sons and rilashons.
For this is My blood of the new covenant, which is shed for many for the remission of sins.
bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.
Jesus said to her, “Your brother will rise again.”
So Jesus tell am, “Yor broda go wake-up again.”
And certain men came down from Judea and taught the brethren, “Unless you are circumcised according to the custom of Moses, you cannot be saved.”
Some men kom from Judea kon dey tish di brodas sey, “Unless dem sekonsaiz una di way Moses tok for di law, una nor go fit get salvashon.”
in Hadid, Zeboim, Neballat;
Hadid, Zeboim, Neballat,
Then they shall be afraid and ashamed of Ethiopia their expectation and Egypt their glory.
Pipol wey trust Ethiopia and bilive sey Egypt go save dem, go fear and shame go katch dem.
From that time Jesus began to preach and to say, “Repent, for the kingdom of heaven is at hand.”
From dat time, Jesus bigin prish sey, “Make una turn from sin kom meet God, bikos God Kingdom don kom meet una.”
“ Some remove landmarks; They seize flocks violently and feed on them;
Stone wey dem take mark land, pipol dey move am komot from where dem put am, so dat dem go get many land; dem still dey tif animals join dia own.
And say to Archippus, “Take heed to the ministry which you have received in the Lord, that you may fulfill it.”
Make una tell Arkippus sey, make e finish di work wey Christ gi-am.
So David, the elders of Israel, and the captains over thousands went to bring up the ark of the covenant of the Lord from the house of Obed-Edom with joy.
So King David, Israel leaders and all di sojas oga, go Obed-Edom house go karry di Kovenant Box kom Jerusalem and dem kon dey sing and dance.
No, you yourselves do wrong and cheat, and you do these things to your brethren!
Instead, una dey play wayo among unasef!
This is the consecrated portion for Aaron and his sons, from the offerings made by fire to the Lord , on the day when Moses presented them to minister to the Lord as priests.
Dis na part for di food wey dem give God, Aaron and en sons for di day wey dem make dem priest.
For the Lord said to Moses, “They shall offer their offering, one leader each day, for the dedication of the altar.”
Bikos God tell Moses sey, “Dem must give dia ofrin to take dedikate di altar; one leader for each day.”
Surely no fear of me will terrify you, Nor will my hand be heavy on you.
So yu nor get rizin to fear mi and I nor go wahala yu too mush.
So the people asked him, saying, “What shall we do then?”
So di pipol kon ask am, “Wetin wi go do naw?”
So they ran and brought him from there; and when he stood among the people, he was taller than any of the people from his shoulders upward.
So dem run go karry am kom from der. Wen e stand with di pipol, e tall pass all of dem.
But I will bring back Israel to his home, And he shall feed on Carmel and Bashan; His soul shall be satisfied on Mount Ephraim and Gilead.
I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.
When the Syrians of Damascus came to help Hadadezer king of Zobah, David killed twenty-two thousand of the Syrians.
Wen Siria pipol for Damaskus send sojas go help King Hadadeza, David attack and kill 22,000 sojas.
For Heshbon was the city of Sihon king of the Amorites, who had fought against the former king of Moab, and had taken all his land from his hand as far as the Arnon.
Heshbon na King Sihon town for Amor. Naw, e don fight against di king wey dey Moab before kon take all en land from der go rish Arnon.
And he showed me a pure river of water of life, clear as crystal, proceeding from the throne of God and of the Lamb.
Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.
And if it seems evil to you to serve the Lord , choose for yourselves this day whom you will serve, whether the gods which your fathers served that were on the other side of the River, or the gods of the Amorites, in whose land you dwell. But as for me and my house, we will serve the Lord .”
If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”
Lying lips are an abomination to the Lord , But those who deal truthfully are His delight.
God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.
but in the place which the Lord chooses, in one of your tribes, there you shall offer your burnt offerings, and there you shall do all that I command you.
Una go only sakrifice am for di place wey God go choose from among una tribe. Na der una go for offa una burnt ofrin and do evritin wey I kommand una.
And Moses and Eleazar the priest received the gold from the captains of thousands and of hundreds, and brought it into the tabernacle of meeting as a memorial for the children of Israel before the Lord .
So Moses and Eleazar di priest kon take di gold from di ofisas go di tent, so dat God go protet Israel pipol.
“But Jeshurun grew fat and kicked; You grew fat, you grew thick, You are obese! Then he forsook God who made him, And scornfully esteemed the Rock of his salvation.
But Israel pipol kon fat and wiked more-more. Di pipol kon heavy, round and tick for body! Dem forget God wey kreate dem; den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon.
So I asked, “What is it?” And he said, “It is a basket that is going forth.” He also said, “This is their resemblance throughout the earth:
So I ask, “Wetin bi dat?” E ansa, “Na basket and na di whole land sin full inside.”
There shall come forth a Rod from the stem of Jesse, And a Branch shall grow out of his roots.
For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.
And the Amorites forced the children of Dan into the mountains, for they would not allow them to come down to the valley;
Amor pipol force Dan tribe go stay for di kountries wey dey di hill and dem nor let dem kom down again.
and for her who is indisposed because of her customary impurity, and for one who has a discharge, either man or woman, and for him who lies with her who is unclean.’ ”
woman wey dey mestrate or man wey sleep with woman wey nor klean.”
Hear, O earth! Behold, I will certainly bring calamity on this people— The fruit of their thoughts, Because they have not heeded My words Nor My law, but rejected it.
Pipol for dis eart! Make una hear dis word: ‘I won bring wahala for dis pipol. E go bi payment for dia wikedness, bikos dem don rijet my law and dem nor gri listin to wetin I tok.
Thus the work of the house of God which is at Jerusalem ceased, and it was discontinued until the second year of the reign of Darius king of Persia.
So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.
But reject profane and old wives’ fables, and exercise yourself toward godliness.
But make una rijet lie-lie and yeye story. Instead make una dey train unasef with betta words from God.
You will know them by their fruits. Do men gather grapes from thornbushes or figs from thistles?
Yu go know dem with wetin dem dey do. Pipol nor dey gada grape or fig from shuku-shuku.
So He brought me into the inner court of the Lord ’s house; and there, at the door of the temple of the Lord , between the porch and the altar, were about twenty-five men with their backs toward the temple of the Lord and their faces toward the east, and they were worshiping the sun toward the east.
So E take mi go inside di kourtyard for di temple. Near di Holy Place gate wey dey near di altar and di varanda, twenty-five men dey der. Dem back di Holy Place kon dey bow face di east, dey woship di sun as e dey raiz.
“Your father made our yoke heavy; now therefore, lighten the burdensome service of your father, and his heavy yoke which he put on us, and we will serve you.”
“Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon remove dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”
Then Hamor the father of Shechem went out to Jacob to speak with him.
So Hamor wey bi Shekem pikin kon meet and tok to Jakob.
The sun and moon stood still in their habitation; At the light of Your arrows they went, At the shining of Your glittering spear.
As dem si yor arrow dey kom with speed and as yor spear dey shine, di sun and di moon nor fit move komot from where dem dey.
When its boughs are withered, they will be broken off; The women come and set them on fire. For it is a people of no understanding; Therefore He who made them will not have mercy on them, And He who formed them will show them no favor.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
And you shall beat some of it very fine, and put some of it before the Testimony in the tabernacle of meeting where I will meet with you. It shall be most holy to you.
Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu.
On the day of the New Moon it shall be a young bull without blemish, six lambs, and a ram; they shall be without blemish.
For di New Moon Festival, e go take one yong melu, six sheep and one ram and all of dem must dey okay.
What does it profit, my brethren, if someone says he has faith but does not have works? Can faith save him?
My brodas and sistas, wetin dey good if pesin sey e get faith, but e nor dey do anytin? Dat kind faith go fit save am?
The word of the Lord that came to Hosea the son of Beeri, in the days of Uzziah, Jotham, Ahaz, and Hezekiah, kings of Judah, and in the days of Jeroboam the son of Joash, king of Israel.
Dis na di message wey God give Hosea, Beeri pikin for di time wey Uzzaya, Jotam, Ahaz and Hezekaya dey rule Judah and wen Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel.
For Mordecai was great in the king’s palace, and his fame spread throughout all the provinces; for this man Mordecai became increasingly prominent.
Dem kon know Mordekai for evriwhere, bikos en pawa for di palis, dey strong evriday.
Professing to be wise, they became fools,
Even doh dem tink sey dem wise, dem bi fools;
Then Jesus answered and said, “O faithless and perverse generation, how long shall I be with you and bear with you? Bring your son here.”
Jesus kon tell dem, “Una wey dey do bad tins and nor gri bilive, how long I go stay with una?” Den e tell di man, “Bring yor pikin kom here.”
“Thus says the Lord , the God of Israel: ‘Go and speak to Zedekiah king of Judah and tell him, “Thus says the Lord : ‘Behold, I will give this city into the hand of the king of Babylon, and he shall burn it with fire.
Di Oga wey bi Israel God sey, “Make yu go tell King Zedekaya for Judah sey, ‘Mi, wey bi God, go give dis town to Babilon king and e go burn am rish groun.
Then the third angel poured out his bowl on the rivers and springs of water, and they became blood.
Di third angel pour wetin dey en basin put for river. Di river and di wota wey dey flow pass, kon turn to blood.
Terrors are turned upon me; They pursue my honor as the wind, And my prosperity has passed like a cloud.
Fear don chop my full body; my respet don go like wota proof wey breeze blow and my glory don vanish like kloud.
They shall not defile themselves anymore with their idols, nor with their detestable things, nor with any of their transgressions; but I will deliver them from all their dwelling places in which they have sinned, and will cleanse them. Then they shall be My people, and I will be their God.
Dem nor go spoil dia body with juju or anytin wey go make dem dirty or sin again. God go free dem from evritin wey dey make dem sin. E go klean dem; dem go bi en pipol and E go bi dia God.’
And the multitudes with one accord heeded the things spoken by Philip, hearing and seeing the miracles which he did.
Di pipol wey gada, put dia mind for wetin Filip dey tok, bikos dem don hear and si all di mirakles wey e do.