english
stringlengths
19
466
pidgin
stringlengths
7
510
So Moses went out of the city from Pharaoh and spread out his hands to the Lord ; then the thunder and the hail ceased, and the rain was not poured on the earth.
So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall.
As an eagle stirs up its nest, Hovers over its young, Spreading out its wings, taking them up, Carrying them on its wings,
Just as di eagle dey wosh en house kon kover en shidren, na so too God spread en feada kon karry dem go up.
“Then I charged Baruch before them, saying,
I tell Baruk for dia present sey,
And he behaved very abominably in following idols, according to all that the Amorites had done, whom the Lord had cast out before the children of Israel.
Na-im kommit di sin wey big pass, wen e go woship juju like Amor pipol wey God drive komot for di land, before Israel pipol kom.)
A man who bears false witness against his neighbor Is like a club, a sword, and a sharp arrow.
To lie for pesin head bi like to kill pesin with swod, wound am with sharp arrow or shot am.
Until the time that his word came to pass, The word of the Lord tested him.
Until di time rish for Josef to do wetin e dream and tok about, God still dey test en karata.
A man who wanders from the way of understanding Will rest in the assembly of the dead.
Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.
By faith Moses, when he became of age, refused to be called the son of Pharaoh’s daughter,
Wen Moses kon grow up, na faith make am nor gri make dem koll am Fero dota pikin.
‘Observe the Sabbath day, to keep it holy, as the Lord your God commanded you.
Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una.
Then news came to Joab, for Joab had defected to Adonijah, though he had not defected to Absalom. So Joab fled to the tabernacle of the Lord , and took hold of the horns of the altar.
Joab hear wetin happen (bikos na Adonijah e bin dey support, even doh e nor support Absalom). So e run go di tent for God present kon hold di altar horn.
For assuredly, I say to you, whoever says to this mountain, ‘Be removed and be cast into the sea,’ and does not doubt in his heart, but believes that those things he says will be done, he will have whatever he says.
I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am.
The ungodly are not so, But are like the chaff which the wind drives away.
But nor bi so e bi for wiked pipol! Instead, dem bi like leaf wey breeze blow trowey.
Gather the people, Sanctify the congregation, Assemble the elders, Gather the children and nursing babes; Let the bridegroom go out from his chamber, And the bride from her dressing room.
Make una gada di pipol; prepare dem for di holy meetin; bring di old pipol, den gada all di shidren too. Even pipol wey just marry must kom out from dia bedroom.
And she said to her father, “Let it not displease my lord that I cannot rise before you, for the manner of women is with me.” And he searched but did not find the household idols.
Den Rashel tell en papa, “Make my oga nor vex sey I nor fit stand, bikos I dey si my period.” So e look evriwhere and e nor si di gods.
Now, I open my mouth; My tongue speaks in my mouth.
Si naw, I don open my mout and my tongue won start to tok.
I was on the verge of total ruin, In the midst of the assembly and congregation.”
Naw, na wons dem disgrace mi for publik.”
“As for you, son of man, the children of your people are talking about you beside the walls and in the doors of the houses; and they speak to one another, everyone saying to his brother, ‘Please come and hear what the word is that comes from the Lord .’
God sey, “Man pikin, yor pipol dey tok about yu wen ever dem meet for di town wall or for dia house door-mot. Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi go hear wetin God tok.’
So he went out and followed him, and did not know that what was done by the angel was real, but thought he was seeing a vision.
Pita follow am go outside. Even doh e bilive sey wetin dey happen so na true, e tink sey na dream e dey dream.
Then the king said to Ittai the Gittite, “Why are you also going with us? Return and remain with the king. For you are a foreigner and also an exile from your own place.
den di king tell Ittai wey bi dia leader sey, “Why yu won follow us go?” Go back make yu go stay with di new king. Yu bi strenja wey dem porshu komot en kountry.
besides what the traveling merchants and traders brought. And all the kings of Arabia and governors of the country brought gold and silver to Solomon.
All dis nor dey join di oda tins wey e dey get from doz wey dey buy and sell. All Arabia kings and govnor from di aria, dey still bring gold and silva kon gi-am.
And Menahem exacted the money from Israel, from all the very wealthy, from each man fifty shekels of silver, to give to the king of Assyria. So the king of Assyria turned back, and did not stay there in the land.
Menahem kollect di silva from di rish pipol wey dey Israel. E take fifty-fifty silva from all of dem kon gi-am to Assyria king. Den Assyria king komot dia land and e nor kom back again.
He arose and attacked the Philistines until his hand was weary, and his hand stuck to the sword. The Lord brought about a great victory that day; and the people returned after him only to plunder.
e stand fight till en hand bigin pain am and en swod kon gum en hand. God give dem viktory dat day. Wen Israel pipol go meet Eleazar afta di fight, di only tin wey remain for dem to do, na to kollect all di tins wey Filistia sojas die leave.
Where then is my hope? As for my hope, who can see it?
any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?
“The Redeemer will come to Zion, And to those who turn from transgression in Jacob,” Says the Lord .
God dey tell en pipol sey, “I go kom Jerusalem kon defend and save all of una wey turn from una sin kom meet mi.
For I do not desire, brethren, that you should be ignorant of this mystery, lest you should be wise in your own opinion, that blindness in part has happened to Israel until the fullness of the Gentiles has come in.
My friends, I nor won make una dey boast about unasef. So I go tell una wetin happen to Israel pipol. Some among dem sturbon well-well and na so dem go bi until di nomba for Gentile pipol wey God wont, don komplete.
Both the gray-haired and the aged are among us, Much older than your father.
Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
Trust in the Lord , and do good; Dwell in the land, and feed on His faithfulness.
Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
And give my son Solomon a loyal heart to keep Your commandments and Your testimonies and Your statutes, to do all these things, and to build the temple for which I have made provision.”
Make Yu give Solomon my pikin di heart to take obey evritin wey Yu kommand, about how dem go take build di temple, wey I don gada tins for.”
Then the Lord said to Moses, “If her father had but spit in her face, would she not be shamed seven days? Let her be shut out of the camp seven days, and afterward she may be received again. ”
God tell Moses, “If to sey na en papa just spit for en face, dem nor go disgrace am for seven days? So make e komot form di kamp for seven days and afta, e fit kom back.”
And Abraham came near and said, “Would You also destroy the righteous with the wicked?
Abraham go meet Oga God kon ask, “Yu won really distroy doz wey nor do bad with doz wey do bad?
Now it happened in the process of time that the king of Egypt died. Then the children of Israel groaned because of the bondage, and they cried out; and their cry came up to God because of the bondage.
Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven.
For you yourselves know how you ought to follow us, for we were not disorderly among you;
Una know sey una suppose to dey imitate us, bikos wi nor bihave anyhow wen wi dey with una.
When all that generation had been gathered to their fathers, another generation arose after them who did not know the Lord nor the work which He had done for Israel.
Afta dat generashon die finish, di next generashon forget God and evritin wey E don do for dem.
“Therefore thus says the Lord concerning the men of Anathoth who seek your life, saying, ‘Do not prophesy in the name of the Lord , lest you die by our hand’—
Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”
And you shall put into the ark the Testimony which I will give you.
Di two small flat stones wey I go rite my kommandment put, yu go put dem inside di box.
They blasphemed the God of heaven because of their pains and their sores, and did not repent of their deeds.
Dem still dey curse God wey dey heaven bikos of di sofa and di sore wey full dia body, but dem nor still gri turn from sin kom meet God.
Behold, is it not of the Lord of hosts That the peoples labor to feed the fire, And nations weary themselves in vain?
But make una dey sure about dis! Oga God wey dey kommand heaven sojas don tok: Evritin wey di nashons dey do nor mean anytin; all dia work go dey yuzles.
So he said, “I am seeking my brothers. Please tell me where they are feeding their flocks. ”
Josef ansa, “I dey find my brodas. Abeg make yu tell mi where dem and di animals dey.”
If Satan casts out Satan, he is divided against himself. How then will his kingdom stand?
So if Satan dey drive Satan komot, e don divide ensef bi dat, den how en kingdom go fit stand?
Surely goodness and mercy shall follow me All the days of my life; And I will dwell in the house of the Lord Forever.
True-true, en goodness and love wey nor dey fail go dey follow mi till I die and I go dey for God house forever and ever.
And when he cut the hair of his head—at the end of every year he cut it because it was heavy on him—when he cut it, he weighed the hair of his head at two hundred shekels according to the king’s standard.
En hair tick and heavy well-well sotey na wons e dey kut am a year wen e don too long. En hair heavy rish five pounds if dem use palis standard take measure am.
Then they said, “Come and let us devise plans against Jeremiah; for the law shall not perish from the priest, nor counsel from the wise, nor the word from the prophet. Come and let us attack him with the tongue, and let us not give heed to any of his words.”
Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”
“I will strengthen the house of Judah, And I will save the house of Joseph. I will bring them back, Because I have mercy on them. They shall be as though I had not cast them aside; For I am the Lord their God, And I will hear them.
“I go make Judah pipol strong and I go save Israel pipol. I go sorry for dem kon bring dem back to dia land. Dem go bi like pipol wey I neva rijet before. Na mi bi Oga dia God and I go ansa all dia prayers.
For now I have chosen and sanctified this house, that My name may be there forever; and My eyes and My heart will be there perpetually.
I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.
Have you an arm like God? Or can you thunder with a voice like His?
Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?
But the Lord plagued Pharaoh and his house with great plagues because of Sarai, Abram’s wife.
But God kon send one bad diziz enter Fero house, bikos of Sarai, Abram wife.
“And it shall be in that day that every prophet will be ashamed of his vision when he prophesies; they will not wear a robe of coarse hair to deceive.
“For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol.
And He took it and ate in their presence.
e kon take am chop for dia front.
“Who is like You, O Lord , among the gods? Who is like You, glorious in holiness, Fearful in praises, doing wonders?
My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?
Yet hear the word of the Lord , O women, And let your ear receive the word of His mouth; Teach your daughters wailing, And everyone her neighbor a lamentation.
I still sey, “Naw, wimen! Make una listin and hear wetin God dey tok. Make una tish una dotas and friends how to kry and sing beri song.
A wild donkey used to the wilderness, That sniffs at the wind in her desire; In her time of mating, who can turn her away? All those who seek her will not weary themselves; In her month they will find her.
Una bi like wiked woman donkey wey grow for desert and bikos e dey find man, e go dey use en nose smell evriwhere weda e go si any one. Nobody fit hold am if e nid to sleep with man. Man donkey nor nid to go find am, bikos na en dey run follow dem.
My Father, who has given them to Me, is greater than all; and no one is able to snatch them out of My Father’s hand.
My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand,
‘If it is an animal that men may bring as an offering to the Lord , all that anyone gives to the Lord shall be holy.
“ ‘If na animal e vow sey e go give God as ofrin, den anytin wey e give to God from dis animal go dey holy.
And the intricately woven band of his ephod that was on it was of the same workmanship, woven of gold, blue, purple, and scarlet thread, and of fine woven linen, as the Lord had commanded Moses.
Di fine belt wey dem weave join di priest garment na di same material with am, so dat e go bi one piece with di gold, blue, purpol and red wool with fine linen, just as God kommand Moses.
He who says he abides in Him ought himself also to walk just as He walked.
Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.
‘Now this is the law of the Nazirite: When the days of his separation are fulfilled, he shall be brought to the door of the tabernacle of meeting.
“ ‘Na Nazirite law bi dis: Wen pesin wey bi Nazirite don finish en vow, e go kon do dis sakrifice. E go-go di tent door-mot
And the son of Pallu was Eliab.
Pallu pikin na Eliab.
O Lord , You have seen how I am wronged; Judge my case.
Yu don si di bad-bad tins wey dem do mi. So my God, make Yu judge my kase, so dat pipol go know sey I dey rite.
and the pillars of the court all around, with their sockets, their pegs, and their cords.
Di pilas for di kourt wey round am with dia socket, dia peg and dia ropes.
He trusted in the Lord God of Israel, so that after him was none like him among all the kings of Judah, nor who were before him.
E trust di Oga wey bi Israel God; so e nor get any king like am wey don rule Judah before or wey go rule Judah again.
“Thus let all Your enemies perish, O Lord ! But let those who love Him be like the sun When it comes out in full strength.” So the land had rest for forty years.
My God, make all yor enemies die like Sisera! But make doz wey love Yu, shine like sun!” So peace kon dey for di land for forty years.
But he said to Him, “Lord, I am ready to go with You, both to prison and to death.”
Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”
For we who live are always delivered to death for Jesus’ sake, that the life of Jesus also may be manifested in our mortal flesh.
Dem always dey won kill wi wey dey alive bikos of Jesus Christ, so dat dem go si Jesus life for awa ordinary body.
because for the work of Christ he came close to death, not regarding his life, to supply what was lacking in your service toward me.
bikos e nearly die bikos of Christ. E put en life for danger, so dat e go fit help mi do wetin una for do, since una nor dey here.
Of Mahli: Eleazar, who had no sons.
From Mahli family na Eleazar bi leader, doh e nor born boy pikin.
saying, “This fellow persuades men to worship God contrary to the law.”
Dem sey, “Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!”
And when they had come to a place called Golgotha, that is to say, Place of a Skull,
Wen dem rish one place wey dem dey koll Golgota (wey mean “Skull Place”),
also the lampstand for the light, its utensils, its lamps, and the oil for the light;
di lite, di lampstand and di tins wey follow am; di lamp cup and oil for di lite;
I will turn My face from them, And they will defile My secret place; For robbers shall enter it and defile it.
I nor go tok wen tif dey distroy and rob my temple.
Now the rest of the acts of Solomon, all that he did, and his wisdom, are they not written in the book of the acts of Solomon?
Evry oda tin wey Solomon do; en works and wisdom, dem rite dem for Solomon history book.
These were the sons of Aholibamah, Esau’s wife, the daughter of Anah, the daughter of Zibeon. And she bore to Esau: Jeush, Jaalam, and Korah.
Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin and Zibeon grand-pikin, na di sons wey e born for Esau bi dis: Jeush, Jalam and Korah.
I gave you your master’s house and your master’s wives into your keeping, and gave you the house of Israel and Judah. And if that had been too little, I also would have given you much more!
I give yu en wifes and kingdom; I make yu king for Judah and Israel. If dem nor rish for yu, I for still give yu many oda tins.
Your covenant with death will be annulled, And your agreement with Sheol will not stand; When the overflowing scourge passes through, Then you will be trampled down by it.
Di agriment wey una make with deat, nor go work again and dem go kansol di one wey una enter with dead body. Wen judgement go kom like strong wave, e go karry una go.
So I sought for a man among them who would make a wall, and stand in the gap before Me on behalf of the land, that I should not destroy it; but I found no one.
“I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody.
Again the word of the Lord of hosts came, saying,
Den Oga God wey dey lead heaven sojas give Zekaraya dis message:
And he did not humble himself before the Lord , as his father Manasseh had humbled himself; but Amon trespassed more and more.
Amon nor respet di Oga wey bi God, just as Manasseh en papa take leta respet am. E even sin pass en papa.
So He who sat on the cloud thrust in His sickle on the earth, and the earth was reaped.
So di pesin wey sidan on-top di kloud, take en knife klear di eart kon harvest evritin wey dey inside.
What then? Shall we sin because we are not under law but under grace? Certainly not!
So na wetin wi go tok? Make wi still dey sin, bikos wi get God grace and wi nor dey under di law again? God forbid!
Honor the Lord with your possessions, And with the firstfruits of all your increase;
Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.
including Ebron, Rehob, Hammon, and Kanah, as far as Greater Sidon.
till e rish Abdon, Ebron, Rehob, Hammon and Kanah and Greata Sidon.
Arise, for this matter is your responsibility. We also are with you. Be of good courage, and do it. ”
So make yu get up, bikos na yor rite to take akshon. Wi dey yor back, so go do as yu fit sey God wont.”
But if your offering is a grain offering baked in a pan, it shall be of fine flour, unleavened, mixed with oil.
If di ofrin na bread wey dem kook for iron plate, dem go make am with flower wey dem mix with olive oil, but make e nor get yist.
Shall they escape by iniquity? In anger cast down the peoples, O God!
So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape!
Will I eat the flesh of bulls, Or drink the blood of goats?
I dey chop melu meat? Abi I dey drink goat blood?
I will turn My hand against you, And thoroughly purge away your dross, And take away all your alloy.
I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.
Take heed, do not turn to iniquity, For you have chosen this rather than affliction.
Make yu dey kareful, so dat yu nor go do bad tin, bikos yu dey sofa.
So rend your heart, and not your garments; Return to the Lord your God, For He is gracious and merciful, Slow to anger, and of great kindness; And He relents from doing harm.
Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.
and say to them, ‘Thus says the Lord of hosts, the God of Israel: “Behold, I will send and bring Nebuchadnezzar the king of Babylon, My servant, and will set his throne above these stones that I have hidden. And he will spread his royal pavilion over them.
Den tell di pipol sey, ‘Mi wey bi Israel God wey dey mighty go bring my savant, King Nebukadnezzar for Babilon kom dis place and e go put en throne kon spread en royal tent on-top dis stone wey Jeremaya beri so.
Now therefore, command that they cut down cedars for me from Lebanon; and my servants will be with your servants, and I will pay you wages for your servants according to whatever you say. For you know there is none among us who has skill to cut timber like the Sidonians.
So make yu send yor men go Lebanon go kut cedar wood for mi. My men go work with dem and I go pay yor men any prize wey yu tok. Yu know sey my men nor sabi kut trees like yor men.”
Depart from evil, and do good; And dwell forevermore.
So, make yu turn from bad tins kon do good and yu go stay for di land forever.
Wherever they went out, the hand of the Lord was against them for calamity, as the Lord had said, and as the Lord had sworn to them. And they were greatly distressed.
Anytime wen Israel pipol go fight war, God dey-dey against dem, just as God tok before and dem sofa well-well.
Now when David arose in the morning, the word of the Lord came to the prophet Gad, David’s seer, saying,
Den God tell Gad wey bi David profet, “Go tell David sey I dey gi-am three tins and make e choose one of dem
So they stayed there a long time with the disciples.
So dem stay der for sometaim with di bilivers.
Shout joyfully to the Lord , all the earth; Break forth in song, rejoice, and sing praises.
So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
And these signs will follow those who believe: In My name they will cast out demons; they will speak with new tongues;
Dis signs go follow pipol wey bilive: With my name, dem go drive demon komot from pipol body; dem go speak new language wey dem nor learn;
Send to all those in captivity, saying, Thus says the Lord concerning Shemaiah the Nehelamite: Because Shemaiah has prophesied to you, and I have not sent him, and he has caused you to trust in a lie—
“Send message go give all di prisonas for Babilon about Shemaya. Mi wey bi God, go ponish Shemaya and all en shidren-shidren. I nor send am, but e tok to una as if en na profet and e make una bilive di lie wey e tell una.
‘And you shall count seven sabbaths of years for yourself, seven times seven years; and the time of the seven sabbaths of years shall be to you forty-nine years.
“ ‘Make una kount seven times seven years and e go bi forty-nine years.
that they may lack bread and water, and be dismayed with one another, and waste away because of their iniquity.
Dia bread and wota go finish; dem go dey for pain and dem go die finish, bikos of dia sin.”
Bukki his son, Uzzi his son, Zerahiah his son,
Abishua na Bukki papa. Na dis Bukki born Uzzi wey bi Zerahaya papa.
that they all may be one, as You, Father, are in Me, and I in You; that they also may be one in Us, that the world may believe that You sent Me.
Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.