english
stringlengths
19
466
pidgin
stringlengths
7
510
Moreover, Ruth the Moabitess, the widow of Mahlon, I have acquired as my wife, to perpetuate the name of the dead through his inheritance, that the name of the dead may not be cut off from among his brethren and from his position at the gate. You are witnesses this day.”
I don buy Rut, wey kom from Moab, Mahlon wife, as my wife, so dat di propaty go still dey Elimelek family and en name go still dey among en pipol and en house. All of una na witness today.”
When Jesus saw him lying there, and knew that he already had been in that condition a long time, He said to him, “Do you want to be made well?”
Wen Jesus si am liedan for der, e kon know sey di man neva fit waka for long time. So, Jesus kon ask am, “Yu won waka?”
My eye also has seen my desire on my enemies; My ears hear my desire on the wicked Who rise up against me.
My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol.
If there is any man among you who becomes unclean by some occurrence in the night, then he shall go outside the camp; he shall not come inside the camp.
If anybody dey among una wey nor dey klean, bikos of wetin e do with en body for nite, e must komot di kamp and e nor go enter for sometaim.
And the inhabitant will not say, “I am sick”; The people who dwell in it will be forgiven their iniquity.
Nobody for Zion go sey, “I know well or I dey sick”, di pipol wey dey der, God go forgive dem dia sins.
‘And the priest shall bring her near, and set her before the Lord .
“ ‘Di priest go take di woman go stand for di altar front.
Then it passed along toward the north side of Arabah, and went down to Arabah.
E from der cross go di lowland for front of Arabah for nort go rish di main Arabah.
He made wreaths of chainwork, as in the inner sanctuary, and put them on top of the pillars; and he made one hundred pomegranates, and put them on the wreaths of chainwork.
E make strong shains kon put dem on-top di pila. E still make one hundred fruits wey get many seeds kon dekorate and join dem to di shains.
Joshua therefore sent them out; and they went to lie in ambush, and stayed between Bethel and Ai, on the west side of Ai; but Joshua lodged that night among the people.
Joshua send dem and dem kon go hide for di west side for Ai, between Ai and Bethel. Dat nite, Joshua stay with di sojas.
Now these are the words of the letter that Jeremiah the prophet sent from Jerusalem to the remainder of the elders who were carried away captive—to the priests, the prophets, and all the people whom Nebuchadnezzar had carried away captive from Jerusalem to Babylon.
Dis na di leta wey I rite go give di priests, profets, leaders and all di oda pipol wey Nebukadnezzar karry as prisona from Jerusalem go Babilon.
the son of Izhar, the son of Kohath, the son of Levi, the son of Israel.
Assir na Ebiasaf pikin and na Korah born Ebiasaf. Korah na Izhar pikin. Na Kohat born Izhar. Levi wey Israel born, na-im bi Kohat papa.
Blessed be the name of the Lord From this time forth and forevermore!
Make praiz bi God name naw and forever!
“The Spirit of the Lord spoke by me, And His word was on my tongue.
“God Spirit dey tok thru mi; en message dey for my lip.
Claudius Lysias, To the most excellent governor Felix: Greetings.
“From Klaudius Lysias to Govnor Felix, I salot yu!
But God raised Him from the dead.
But God raiz am from deat
You have become guilty by the blood which you have shed, and have defiled yourself with the idols which you have made. You have caused your days to draw near, and have come to the end of your years; therefore I have made you a reproach to the nations, and a mockery to all countries.
Una really kill pipol and na di juju wey una dey serve, dey dirty una. So una day dey kom and una time go soon end! Na dis make mi allow nashons and kountries dey laf and fool una.
But after long abstinence from food, then Paul stood in the midst of them and said, “Men, you should have listened to me, and not have sailed from Crete and incurred this disaster and loss.
Afta dem don stay without food for many days, Paul stand for dia front kon sey, “My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala.
with three rows of heavy stones and one row of new timber. Let the expenses be paid from the king’s treasury.
Make dem build di wall with one layer and make wood dey on-top each layer. Na di pesin wey dey keep di royal money, go pay for evritin.
Let the redeemed of the Lord say so, Whom He has redeemed from the hand of the enemy,
Make pipol wey God don save, tok about am. Make dem tell odas sey E don save dem from dia enemies.
“Lie also on your left side, and lay the iniquity of the house of Israel upon it. According to the number of the days that you lie on it, you shall bear their iniquity.
“Den, sleep with yor left side kon put Israel sins on-top yor body. And for di days wey yu take sleep with yor left side, Israel pipol sin go dey yor head.
Your teeth are like a flock of sheep Which have come up from the washing; Every one bears twins, And none is barren among them.
Yor tit white like sheep wey dem just wosh klean; each of di tit na two dem bi and dem komplete.
that He might present her to Himself a glorious church, not having spot or wrinkle or any such thing, but that she should be holy and without blemish.
E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am.
Then he went to the gateway which faced east; and he went up its stairs and measured the threshold of the gateway, which was one rod wide, and the other threshold was one rod wide.
Den e klimb go di east gate go measure where dem dey pass enter and e deep rish ten and half fit.
They are exalted for a little while, Then they are gone. They are brought low; They are taken out of the way like all others; They dry out like the heads of grain.
Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
but you have risen up against my father’s house this day, and killed his seventy sons on one stone, and made Abimelech, the son of his female servant, king over the men of Shechem, because he is your brother—
But today, una don turn una back against my papa family. Una kill en 70 son on-top one stone. Abimelek na en pikin wey di savant woman born for am and na una family, so una kon make am king for Shekem.
“I know that you are Abraham’s descendants, but you seek to kill Me, because My word has no place in you.
I know sey una kom from Abraham family, but una won kill mi bikos una nor won hear wetin I dey tok.
“When there is famine in the land, pestilence or blight or mildew, locusts or grasshoppers; when their enemies besiege them in the land of their cities; whatever plague or whatever sickness there is;
Time go kom wen honga go full di eart; diziz, trobol or lokust go dey chop anytin wey dem si; dia enemies go set trap for dem for evriwhere and some oda bad diziz and trobols go happen.
Therefore King Darius signed the written decree.
So King Darius give and sign di orda.
Now therefore, know certainly that you shall die by the sword, by famine, and by pestilence in the place where you desire to go to dwell.”
So make una remember sey; una go die for war and honga and diziz go kill una for di land wey una dey run go stay.”
And they tied to it a blue cord, to fasten it above on the turban, as the Lord had commanded Moses.
Den dem tie one blue rope join am with di priest kap for top, just as God kommand Moses.
His sons are far from safety, They are crushed in the gate, And there is no deliverer.
Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt.
And you shall also make two boards for the two back corners of the tabernacle.
Yu go make two frame for di tent korna for di two back-side.
And the rest of the perverted persons, who remained in the days of his father Asa, he banished from the land.
E remove all di men and wimen ashawo wey dey woship for di juju altars; di ones wey still remain wen Asa, en papa bi king.
Now his servant Zimri, commander of half his chariots, conspired against him as he was in Tirzah drinking himself drunk in the house of Arza, steward of his house in Tirzah.
Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der.
if it happens that the king’s wrath rises, and he says to you: ‘Why did you approach so near to the city when you fought? Did you not know that they would shoot from the wall?
e fit vex ask yu, ‘Why una go near di town go fight dem? Una nor know sey dem go shot arrow from di walls?
And the Lord said to Satan, “From where do you come?” So Satan answered the Lord and said, “From going to and fro on the earth, and from walking back and forth on it.”
God ask Satan, “Where yu from dey kom?” Satan ansa, “I just dey waka anyhow for di world.”
But the people answered, “You shall not go out! For if we flee away, they will not care about us; nor if half of us die, will they care about us. But you are worth ten thousand of us now. For you are now more help to us in the city.”
But dem ansa. “Yu nor go follow us, bikos e nor go mean anytin to di enemy if wi wey remain turn and run or even if dem kill half of us, but only yu bi like 10,000 of us. E go betta make yu stay here dey send help kom give us.”
Then there shall be a great cry throughout all the land of Egypt, such as was not like it before, nor shall be like it again.
Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again.
Then they said to him, “Where is Sarah your wife?” So he said, “Here, in the tent.”
Den dem kon ask am, “Where yor wife Sarah?” Abraham ansa, “E dey inside house.”
“You shall count seven weeks for yourself; begin to count the seven weeks from the time you begin to put the sickle to the grain.
From di day wey una bigin harvest, make una kount seven weeks.
“From above He has sent fire into my bones, And it overpowered them; He has spread a net for my feet And turned me back; He has made me desolate And faint all the day.
E send fire kom from heaven and e dey burn inside my bone. E set trap for mi and I fall enter. Naw E don forget mi and I dey sofa well-well.
They shall eat those things with which the atonement was made, to consecrate and to sanctify them; but an outsider shall not eat them, because they are holy.
Na dem go still chop di bread and meat wey dem take klean and santify dem. No oda pesin go chop from dem, bikos di food dey holy.
So when the centurion and those with him, who were guarding Jesus, saw the earthquake and the things that had happened, they feared greatly, saying, “Truly this was the Son of God!”
Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
The nakedness of your father or the nakedness of your mother you shall not uncover. She is your mother; you shall not uncover her nakedness.
Make una nor sleep with una mama, bikos una don disgrace una papa bi dat. Di woman na yor mama, so yu must nor sleep with am.
At that time Solomon held a feast, and all Israel with him, a great assembly from the entrance of Hamath to the Brook of Egypt, before the Lord our God, seven days and seven more days—fourteen days.
For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
You are already clean because of the word which I have spoken to you.
Una dey klean already, bikos of di word wey I tell una.
Then they took the body of Jesus, and bound it in strips of linen with the spices, as the custom of the Jews is to bury.
Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri.
Then the Lord appeared to him by the terebinth trees of Mamre, as he was sitting in the tent door in the heat of the day.
God appear to Abraham near Mamre oak tree as e sidan for front of en house for one hot aftanoon.
So he carried me away in the Spirit into the wilderness. And I saw a woman sitting on a scarlet beast which was full of names of blasphemy, having seven heads and ten horns.
So for di vishon, di angel karry mi go wildaness and for der, I kon si one woman sidan on-top one red beast and wetin dem rite for en body, na to curse God. Di beast get seven heads and ten horns.
And Mordecai had brought up Hadassah, that is, Esther, his uncle’s daughter, for she had neither father nor mother. The young woman was lovely and beautiful. When her father and mother died, Mordecai took her as his own daughter.
Mordekai get one fine kousin wey en name na Estha and en Hibru name na Hadassa. Wen di girl papa and mama die, Mordekai take and train am as en own pikin.
But the lad did not know anything. Only Jonathan and David knew of the matter.
Di savant nor undastand wetin dey happen. Na only Jonatan and David know wetin dey happen.
For so it was commanded me by the word of the Lord , saying, ‘You shall not eat bread, nor drink water, nor return by the same way you came.’ ”
God kommand mi sey, make I nor chop or drink anytin and make I nor go back di wey I take kom here.”
For the wicked are reserved for the day of doom; They shall be brought out on the day of wrath.
Di day wey God go vex ponish pipol, na di wiked ones E go sorry for.
This is the gate of the Lord , Through which the righteous shall enter.
Na dis gate dem dey pass go God present and pipol wey dey obey God, dey pass der enter.
And Samuel said to all the people, “Do you see him whom the Lord has chosen, that there is no one like him among all the people?” So all the people shouted and said, “Long live the king!”
Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”
Then I saw another angel flying in the midst of heaven, having the everlasting gospel to preach to those who dwell on the earth— to every nation, tribe, tongue, and people—
Den I si anoda angel dey fly for sky and e karry di Good News wey go dey forever dey kom prish give di pipol for dis eart, kountries, tribes, language and groups.
Who is this who comes from Edom, With dyed garments from Bozrah, This One who is glorious in His apparel, Traveling in the greatness of His strength?— “I who speak in righteousness, mighty to save.”
“Who bi dis pesin wey dey kom from Bozrah wey dey Edom? Who wear fine red klot dey waka kom with pawa and strent?” Na mi God wey dey speak with raitiousness, wey dey mighty and get pawa to save.
Then you shall know that I am the Lord , when their slain are among their idols all around their altars, on every high hill, on all the mountaintops, under every green tree, and under every thick oak, wherever they offered sweet incense to all their idols.
Dead body go skata round dia juju and en altars; both for dia hill and on-top evry mountin, under evry green tree and evry oak tree and for evriwhere wey dem for dey burnt sakrifice give dia juju. Dat time, evribody go know sey na mi bi God.
of the sons of Zattu: Elioenai, Eliashib, Mattaniah, Jeremoth, Zabad, and Aziza;
From Zattu family: Elioenai, Eliashib, Matanaya, Jerimot, Zabad and Aziza.
The Lord bless you out of Zion, And may you see the good of Jerusalem All the days of your life.
Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.
And if a stranger dwells with you, or whoever is among you throughout your generations, and would present an offering made by fire, a sweet aroma to the Lord , just as you do, so shall he do.
And if strenja dey stay among una, weda na for sometaim or forever and dem won offa ofrin wey get sweet smell to God, dem must follow di rules and regulashon.
I waited patiently for the Lord ; And He inclined to me, And heard my cry.
I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry.
Then Isaac his father answered and said to him: “Behold, your dwelling shall be of the fatness of the earth, And of the dew of heaven from above.
So en papa Isaak kon tell am, “True-true, where yu dey nor go get di good wey di land dey give and di dew for di sky nor go fall for yor place.
Then Job answered and said:
Job ansa:
And as for the villages with their fields, some of the children of Judah dwelt in Kirjath Arba and its villages, Dibon and its villages, Jekabzeel and its villages;
But for di village around dia fields, some among di pipol for Judah dey stay Kiriat-Arba, Dibon and Jekabzeel with di place and village wey dey der.
Then Jacob did so and fulfilled her week. So he gave him his daughter Rachel as wife also.
Jakob kon do as Laban tok. Wen Jakob don do all di tins wey e suppose do, Laban kon gi-am en sekond pikin, Rashel.
For Your servants take pleasure in her stones, And show favor to her dust.
Bikos yor pipol love all di stones wey dey di town wall and di dust wey dey di street.
This is the will of the Father who sent Me, that of all He has given Me I should lose nothing, but should raise it up at the last day.
Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day.
So he said to his servant, “Come, let us draw near to one of these places, and spend the night in Gibeah or in Ramah.”
Make wi waka fast, so dat wi go fit rish Gibeah or Rama, den wi go sleep for any of di towns.”
“Speak to the children of Israel, saying: ‘You shall not eat any fat, of ox or sheep or goat.
“Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Make una nor chop di fat wey dey kattle, sheep or goat.
‘The man who commits adultery with another man’s wife, he who commits adultery with his neighbor’s wife, the adulterer and the adulteress, shall surely be put to death.
If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman.
Our bones are scattered at the mouth of the grave, As when one plows and breaks up the earth.
Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.
“I will tell you, hear me; What I have seen I will declare,
If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
You also took up the tabernacle of Moloch, And the star of your god Remphan, Images which you made to worship; And I will carry you away beyond Babylon.’
‘Na bikos of di house wey una build for “Molek and Refan”, wey bi una god and juju wey una dey woship, naim make mi send una go bi slave for Babilon.’
And they set in it four rows of stones: a row with a sardius, a topaz, and an emerald was the first row;
Dem put four row of stones on-top am: di first row na with rubi stone, topaz stone and beryl stone.
And the Angel of the Lord appeared to him, and said to him, “The Lord is with you, you mighty man of valor!”
Di angel appear to am kon sey, “Strong man, God dey with yu!”
Create in me a clean heart, O God, And renew a steadfast spirit within me.
My God, make Yu put betta heart inside mi and make yor spirit strong inside mi too.
Before the throne there was a sea of glass, like crystal. And in the midst of the throne, and around the throne, were four living creatures full of eyes in front and in back.
Di throne front dey shine like mirror and e bi like crystal. For centre and around di throne, for creatures wey get eye full body, dey for der too.
Provide atonement, O Lord , for Your people Israel, whom You have redeemed, and do not lay innocent blood to the charge of Your people Israel.’ And atonement shall be provided on their behalf for the blood.
So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all.
And he shall take a wife in her virginity.
Na only virgin di High Priest go fit marry.
‘But if he is too poor to pay your valuation, then he shall present himself before the priest, and the priest shall set a value for him; according to the ability of him who vowed, the priest shall value him.
If e nor get money take pay en vow, e must take di pesin to di priest and di priest go reduce di money, akordin to wetin di pesin go fit pay.
And the woman whom you saw is that great city which reigns over the kings of the earth.”
And di woman wey yu si, na Babilon, di big town wey get pawa to rule all di kings for di world.”
Everyone who touches its flesh must be holy. And when its blood is sprinkled on any garment, you shall wash that on which it was sprinkled, in a holy place.
Anybody wey tosh di animal meat must dey holy and anybody wey di animal blood stain en garment or di Holy Place, must wosh am.
And Jonathan said to David, “Come, let us go out into the field.” So both of them went out into the field.
Jonatan ansa David, “Kom make wi go di field.” Wen dem two dey go di field,
So David said to Saul, “Who am I, and what is my life or my father’s family in Israel, that I should be son-in-law to the king?”
David kon tell Saul, “Who I bi? Who bi my family or my papa tribe for Israel wen I go kom bi di king in-law?”
‘And every creeping thing that creeps on the earth shall be an abomination. It shall not be eaten.
“ ‘Una must nor chop any animal wey dey creep for groun,
The rings shall be close to the frame, as holders for the poles to bear the table.
Di rings go dey near di rim and e go bi di poles wey dem go take dey karry di tabol.
“So they shall put My name on the children of Israel, and I will bless them.”
So my name go always dey Israel pipol mout and I go bless dem.”
He shall bring it to Aaron’s sons, the priests, one of whom shall take from it his handful of fine flour and oil with all the frankincense. And the priest shall burn it as a memorial on the altar, an offering made by fire, a sweet aroma to the Lord .
kon take am go give Aaron sons wey bi priest. Di priest go pak di flower, oil and all di incense full en hand kon burn am for di altar as part of di ofrin wey dem give God. God like dis food ofrin smell well-well.
So it was, when the king saw Queen Esther standing in the court, that she found favor in his sight, and the king held out to Esther the golden scepter that was in his hand. Then Esther went near and touched the top of the scepter.
Wen di king si Estha for di gate, belle sweet am, den e stresh en gold rod and Estha kon go tosh di rod.
And you say, ‘What does God know? Can He judge through the deep darkness?
But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’
all the cities of the plain and all the kingdom of Sihon king of the Amorites, who reigned in Heshbon, whom Moses had struck with the princes of Midian: Evi, Rekem, Zur, Hur, and Reba, who were princes of Sihon dwelling in the country.
Dis na all di towns for di aria plus di ones wey King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon, get. Moses win en and Midian leaders wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba (all of dem dey under King Sihon).
“ Is not the Lord your God with you? And has He not given you rest on every side? For He has given the inhabitants of the land into my hand, and the land is subdued before the Lord and before His people.
E tell dem, “Di Oga wey bi una God dey with una and E don give una peace for evry side. E make mi win all di pipol wey dey stay dis land and dem dey under una and God.
And He said to them, “When I sent you without money bag, knapsack, and sandals, did you lack anything?” So they said, “Nothing.”
Den Jesus tell dem, “Wen I send una go out, without money, bag or sandals, e get anytin wey una nid wey una nor get?” Dem ansa, “No!”
But the hand of the Lord was heavy on the people of Ashdod, and He ravaged them and struck them with tumors, both Ashdod and its territory.
God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.
The enemy shall not outwit him, Nor the son of wickedness afflict him.
En enemies nor go fit win am and wiked pipol pawa nor go fit opress am.
I was at ease, but He has shattered me; He also has taken me by my neck, and shaken me to pieces; He has set me up for His target,
I dey live for peace before, but God don skata mi. E seize mi for my neck kon skata my life. E dey plan against mi.
So the Lord God said to the serpent: “Because you have done this, You are cursed more than all cattle, And more than every beast of the field; On your belly you shall go, And you shall eat dust All the days of your life.
God kon tell di snake, “Bikos yu do like dis, “For all di wild animals wey I kreate for dis eart, curse dey yor head! Na belle yu go take dey waka and na san-san yu go dey chop for all yor life.
It came to pass after these things that the butler and the baker of the king of Egypt offended their lord, the king of Egypt.
Afta all dis tins don happen, di pesin wey dey serve wine for Egypt king and di pesin wey dey bake en bread kon make am vex.
You shall not shave around the sides of your head, nor shall you disfigure the edges of your beard.
Una must nor kut di hair wey kover una head or barb una bear-bear,