conversations
listlengths
2
2
[ { "role": "user", "content": "Nooo, that one different. Basil don dey suffer heartbreak since" }, { "role": "assistant", "content": "As in…" } ]
[ { "role": "user", "content": "He don dey suffer heartbreak since. O boy that," }, { "role": "assistant", "content": "But, but the way wey Basil relationship and that girl take dey, e just dey as if immediately dem go marry" } ]
[ { "role": "user", "content": "That is why…" }, { "role": "assistant", "content": "When I see her this thing on facebook ehhen Jesus!" } ]
[ { "role": "user", "content": "I can never talk to any girl, any, any girl again in my life" }, { "role": "assistant", "content": "And that boy na pretty high boy wey she marry o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Yes nah, our set o. I can never touch any girl. The girl wey be say e go come from house eh, carry Ghana must go of provision of everything, we go dey my room nah, dem go come carry come give Basil say, you know say Basil no too get cash then,The guy people owe and Basil dey teach am that’s why she dey close that time, So, e get gift Basil dey pull me na so e just carry am… well done, well done" }, { "role": "assistant", "content": "So, the thing was so much that, dem won even won do the wedding before o, something spoil am. The sister won do wedding, dem say mey im sister do first when we dey school that time, dem won rush am do mtchew, dem say make the sister do, after the sister, Basil don go meet the parents sef. Basil don go meet the girl parents, dem don seal everything, hai! The thing pain me. But when I come discover now, why I come dey, wetin dey pain me now be say, you know say Joy dey get crush on Timothy" } ]
[ { "role": "user", "content": "Timothy?" }, { "role": "assistant", "content": "Uhhn, Timothy nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wey be…" }, { "role": "assistant", "content": "Librarian" } ]
[ { "role": "user", "content": "Which of the Timothy? Librarian" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhen, na im nah. Ehhennah. So that time now later, when this guy come dey take dem on tutorial; Basil, dem come dey get close walk, im and God. Give am run, give am run. You know say Basil only go for the church, from church, from AG here, say Basil how far, Basil say make she come mtchew she vex. When we come reach the place, the girl come dey find Basil" } ]
[ { "role": "user", "content": "Why?" }, { "role": "assistant", "content": "Dey look for Basil" } ]
[ { "role": "user", "content": "Why im dey find am?" }, { "role": "assistant", "content": "No be im… person where im heart dey be that? Later she come dey send message give this guy, wetin be im name, Timothy" } ]
[ { "role": "user", "content": "She wan leave her husband for then marry," }, { "role": "assistant", "content": "Na im she send message give to Timothy say make Timothy come see im pikin nah. Say im know say she love Timothy, ahn, ahn" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahn, ahn, mama Joy She dey Okay" }, { "role": "assistant", "content": "See, you know say that man," } ]
[ { "role": "user", "content": "Or something dey worry am" }, { "role": "assistant", "content": "The age difference between them nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "E too much" }, { "role": "assistant", "content": "Too much. The age difference too much" } ]
[ { "role": "user", "content": "When pesin go, go marry im papa mate" }, { "role": "assistant", "content": "But she has a>" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wetin enter inside her?" }, { "role": "assistant", "content": "She has a reason" } ]
[ { "role": "user", "content": "Is it the money or what?" }, { "role": "assistant", "content": "Family …, she need small thing to lift the family, understand? And … Basil never gain job. … all of us still been dey find, we still dey school that time" } ]
[ { "role": "user", "content": "DELSU" }, { "role": "assistant", "content": "No, nobody know say na like this im go turn am to mean. So…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where Basil dey now sef?" }, { "role": "assistant", "content": "Mtchew. Oboy that guy just go, na Abuja he dey o. He just go hide, he no go mtchew, for im to show" } ]
[ { "role": "user", "content": "Hello, How far? Good evening. How you dey? How your exams? No wahala. Wey that lefty nah, where una dey? Hello, you don go house? Una no get card, una go dey call; mey una flash, I go call you." }, { "role": "assistant", "content": "My dear, na so the matter heavy o, the thing pain me eh. When this girl come do her own, Vivian come do her own now I say, Kai!" } ]
[ { "role": "user", "content": "When me I see the thing eh, as I wan open the picture, na Basil I dey expect to see" }, { "role": "assistant", "content": "Everybody expect to see Basil near the girl. When dem just see the girl like this, eh, another guy" } ]
[ { "role": "user", "content": "Na immediately I just call you say wetin dey happen" }, { "role": "assistant", "content": "Google fit say na PTI boy again and I’m…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Fine boy Hmm mtchew" }, { "role": "assistant", "content": "You sabi, all these girls," } ]
[ { "role": "user", "content": "Nawao" }, { "role": "assistant", "content": "All this una, all these girls" } ]
[ { "role": "user", "content": "E no fit them" }, { "role": "assistant", "content": "Im own better o. Me sef I see na two of you beta. You know my guy, Roma, sorry. Hello! You know Roma nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Roma…" }, { "role": "assistant", "content": "Roma wey be say na my course mate. Roma wey did im ND here, na player im be, when he come back for HND, ah, how far nah? Bawoni? Ekuise" } ]
[ { "role": "user", "content": "Good evening" }, { "role": "assistant", "content": "So, when Roma con come back for HND, Roma come dey continue im player stuff with the other girls sorry. E come get one girl, Blessing. Blessing na im be Isoko… this thing nah mtchew" } ]
[ { "role": "user", "content": "Is like I know the girl" }, { "role": "assistant", "content": "Life" } ]
[ { "role": "user", "content": "Life, he come dey focused. Pesin wey be say Roma carry, Blessing carry Apollo from hostel come give Roma for room. Roma carry am give me, me I carry am go church village that time wey I dey use glass do exam, I carry am go church village. Na so we dey share Apollo. Can you believe that a week to exam, this girl bring her wedding card come give us for room, all of us dey room. We dey N&E27, all of us sit down like this, she carry wedding card come" }, { "role": "assistant", "content": "She get mind o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Roma dey, all of us dey, all of us dey like this sit down. She say this is my card for my wedding, I want you guys to come. When we open the… this thing, na formal PTI student wey dey work for… Chevron" }, { "role": "assistant", "content": "Heeeey! If na me sef, I will marry" } ]
[ { "role": "user", "content": "Nooo nau" }, { "role": "assistant", "content": "But and the boy was there" } ]
[ { "role": "user", "content": "He was there. Come join mata," }, { "role": "assistant", "content": "She get mind" } ]
[ { "role": "user", "content": "She come talk say ehhhen, all of us have to come for the wedding mtchew. We just collect the card, we keep am. As she just waka go mtchew, oboy, look the guy like this" }, { "role": "assistant", "content": "That boy go cry o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Roma nah wey dey, e no dey date one girl o. any girl wey come, he just dey reason say noo he can’t love again" }, { "role": "assistant", "content": "Hei!" } ]
[ { "role": "user", "content": "The one wey you see come put you love come say you love, yes you don see true love. No be when I dey Lagos na im I dey work with nah when you come that time. When I dey go beach, dey change, you dey see, e dey send picture for this… so with me guy, guy I can’t love again" }, { "role": "assistant", "content": "Ahhn, if you no fit love again and if you" } ]
[ { "role": "user", "content": "The guy, the guy dey Warri here now" }, { "role": "assistant", "content": "If you really love, it will take it, it will take time" } ]
[ { "role": "user", "content": "It will take time. Imagine that kind of thing" }, { "role": "assistant", "content": "Hmmm, it's killing o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Eh!" }, { "role": "assistant", "content": "Hia!" } ]
[ { "role": "user", "content": "Somebody that was something before. Ewonieleyi? Je n wo… Love letter lo nkani, ta lo n sendi e, which one?" }, { "role": "assistant", "content": "I will not go till it’s Wednesday" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wednesday, what happened, seems their hostel is not open, do you have anything… still there?" }, { "role": "assistant", "content": "Yes o, welfare still dey write exam, to sleep go dey fear am" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahhn-ahhhnn. So, you are going on,.. next tomorrow, abi? What are you bringing for me when you come back?" }, { "role": "assistant", "content": "Drinking garri" } ]
[ { "role": "user", "content": "Me garri, garri Ijebu or which one?" }, { "role": "assistant", "content": "Garri Ijebu" } ]
[ { "role": "user", "content": "Only garri Ijebu? What you got during your… interview, I never… I never forget o; when you chop alone. This girl bring something come from exam interview, she chop am alone, come talk say make I no tell her mummy, wey my phone sef, mey I even call am now" }, { "role": "assistant", "content": "Since that time, you never still forget" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no go forget o" }, { "role": "assistant", "content": "Since 2017" } ]
[ { "role": "user", "content": "I can’t forget . You and Alabi are now working hand in hand now. Which kind laugh be that, has he inject you?" }, { "role": "assistant", "content": "Who is the Bella here sef? where im go?" } ]
[ { "role": "user", "content": "You no whether dem don pay Bella school fees, Bella no dey im room" }, { "role": "assistant", "content": "Isoku wetin we go eat, I dey hungry?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wetin you won chop?" }, { "role": "assistant", "content": "Food nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Food for where, where we go chop??" }, { "role": "assistant", "content": "Dem dey sell food for there" } ]
[ { "role": "user", "content": "You no cook for room?" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. Make person cook this exam time. You no even dey pity person" } ]
[ { "role": "user", "content": "Exam don finish nah" }, { "role": "assistant", "content": "Exam dey and no time" } ]
[ { "role": "user", "content": "Even in our time, we use to cook, shey you know, we use to cook" }, { "role": "assistant", "content": "After the paper, I see; I no dey even see anything, na sleep, sleep dey my eyes hmm, mtcheW" } ]
[ { "role": "user", "content": "And you never chop" }, { "role": "assistant", "content": "I go sleep o, no be…" } ]
[ { "role": "user", "content": "But you know in our time we use to cook, shey you know?" }, { "role": "assistant", "content": "Because you people are super intelligent" } ]
[ { "role": "user", "content": "Nooo, na God o, we dey cook" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. We, we are just coming up. We are trying to…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Wey you dey on distinction, you tell me say you are coming up" }, { "role": "assistant", "content": "E concern you?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Distinction. You are coming up. Na DT she dey ooo" }, { "role": "assistant", "content": "Na so. I no dey DT ooo" } ]
[ { "role": "user", "content": "No be upper you dey?" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhhen" } ]
[ { "role": "user", "content": "3.59" }, { "role": "assistant", "content": "So, chinekemo…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Abi the day of convocation now, they will give you award nah. Best graduate girl, female… SLT" }, { "role": "assistant", "content": "Hmm… I pray say…" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no say" }, { "role": "assistant", "content": "Me I no know o" } ]
[ { "role": "user", "content": "For that una class ehen, una get people wey get, we get brain o, brain dey" }, { "role": "assistant", "content": "The competition eh" } ]
[ { "role": "user", "content": "Brain too much. Uju dey, Oluchi, all of una" }, { "role": "assistant", "content": "As in" } ]
[ { "role": "user", "content": "Kai!" }, { "role": "assistant", "content": "The thing just dey like we dey in a race" } ]
[ { "role": "user", "content": "No, no, no, no. Some of una for drop enter this one, ND1, make una come dey do HND1, make e come deyyy, but all of una just come the same time" }, { "role": "assistant", "content": "Nobody won gree for anybody" } ]
[ { "role": "user", "content": "E too much from this one" }, { "role": "assistant", "content": "Oya nah, 2" } ]
[ { "role": "user", "content": "What do you say, what do we eat?" }, { "role": "assistant", "content": "Food nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where?" }, { "role": "assistant", "content": "Dem dey sell food there" } ]
[ { "role": "user", "content": "_ Hmmm. I cannot eat all this kind of food" }, { "role": "assistant", "content": "Oya make we go ShopRite" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahhnahn, ice cream" }, { "role": "assistant", "content": "Wetin you talk" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ice cream" }, { "role": "assistant", "content": "But there’s no light<" } ]
[ { "role": "user", "content": "The, if you reach ShopRite you go see" }, { "role": "assistant", "content": "ShopRite?" } ]
[ { "role": "user", "content": "Oya, mey will go AJ" }, { "role": "assistant", "content": "I don go like this, AJ? Oya mey will go nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Oya nah" }, { "role": "assistant", "content": "Na bread we go just buy nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "Which bread?" }, { "role": "assistant", "content": "Ahn, ahn, sardine bread" } ]
[ { "role": "user", "content": "I be… I be aboki?" }, { "role": "assistant", "content": "Sardine bre, no be Abuja you dey stay? No be near aboki people you dey…" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no want bread, na food I want" }, { "role": "assistant", "content": "Which food you won chop?" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no like bread" }, { "role": "assistant", "content": "E say e no like bread" } ]
[ { "role": "user", "content": "I no like bread, I swear" }, { "role": "assistant", "content": "Bread go dey hang person for throat" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ahn, ehhen nau" }, { "role": "assistant", "content": "Thank God s… thank God you be na my sister, my wife go know how to do, how to do bread. Bread must dey, everyday bread must dey the house" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ehhhen?" }, { "role": "assistant", "content": "Bread must dey" } ]
[ { "role": "user", "content": "Because of wetin?" }, { "role": "assistant", "content": "Ah! see, na bakery you dey see so o, if I dey go work eh, I dey carry like four Delta bread go office" } ]
[ { "role": "user", "content": "Why? And you go finish am?" }, { "role": "assistant", "content": "Yes nah. Today, e don finish" } ]
[ { "role": "user", "content": "Bright! How far nah?" }, { "role": "assistant", "content": "I just dey, you don finish" } ]
[ { "role": "user", "content": "Good evening, na so ooo" }, { "role": "assistant", "content": "How far?" } ]
[ { "role": "user", "content": "When are you leaving?" }, { "role": "assistant", "content": "I’m not leaving o, I’m around. Olori, I dey come" } ]
[ { "role": "user", "content": "No be you dey shout immediately after your paper, you are going" }, { "role": "assistant", "content": "Ehhhen, all na whining, all nah whining" } ]
[ { "role": "user", "content": "That boy wey you first you go. Na Yoruba person?" }, { "role": "assistant", "content": "Like seriously" } ]
[ { "role": "user", "content": "Your set too small, no be say… the guy is large" }, { "role": "assistant", "content": "Na so" } ]
[ { "role": "user", "content": "OND? God forbid. PT, PTI no tall, all these shanku, shanku, shankulu boys come dey dey position" }, { "role": "assistant", "content": "As in…" } ]
[ { "role": "user", "content": "Where are the big boys?" }, { "role": "assistant", "content": "E tire me o" } ]
[ { "role": "user", "content": "Cult no dey school again, cult no dey" }, { "role": "assistant", "content": "Yes. Cult dey hostel" } ]
[ { "role": "user", "content": "But na small, small boys na in dey now Our own time na ma…" }, { "role": "assistant", "content": "All these ND1" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ehhen, our own time na matured men be cultist that time nah. Dem go even see their eyes sef, you go fear<CS>" }, { "role": "assistant", "content": "Hmmm. This one when im slap you, nothing you won do o" } ]
[ { "role": "user", "content": "For this school?" }, { "role": "assistant", "content": "You go just tell am sorry waka go" } ]
[ { "role": "user", "content": "Ah, nooo mtchew, but it’s good sha. All this things, there is no, no gain but they can’t know now, when they leave the system" }, { "role": "assistant", "content": "They can’t know sha" } ]
[ { "role": "user", "content": "They can’t know" }, { "role": "assistant", "content": "Is when they leave that they will know that they are living in risked life" } ]
[ { "role": "user", "content": "You know what gave them the power, privilege now, because they are seeing themselves everyday" }, { "role": "assistant", "content": "Yeah" } ]
[ { "role": "user", "content": "When you leave school now, some will go Ijebu, you will go Abuja, before you go call any of your mate, hmm, you go know say ah, for this cult wey I join, e no help me o…" }, { "role": "assistant", "content": "Yes o" } ]
[ { "role": "user", "content": "E no help me o but now because Orji, Orokpa, they are rolling, doing everything together mtchew but if anything won sup, he go call this one. No worry, no worry. So, Olori wetin you won chop?" }, { "role": "assistant", "content": "You always decide it nah" } ]
[ { "role": "user", "content": "You always decide it. Mey we go cook nah, mey will go cook, mey we go cook rice, mey we go cook . Ahn, kai, no swallow me nahhh, Olori" }, { "role": "assistant", "content": "P/P Hmmm… ice cream" } ]